But Joab and Abishai bigin porshu Abner from evening till dem rish Ammah hill, near Giaya wey dey east for di side wey dey di road wey dem dey pass go Gibeon wildaness.
Abner koll Joab kon sey, “Na so wi go dey fight forever? Yu nor dey si sey wi nor go gain anytin, apart from wahala? Wi bi yor kountry pipol. Wen yu go tell yor men make dem stop to porshu us?”