21 Abner kon sey, “Make yu stop to porshu mi, but run follow one of di sojas make yu kollect wetin e get.” But Asahel nor gri.
Abner look back kon sey, “Asahel! Na yu bi dat?” Asahel ansa, “Yes! Na mi.”
Abner kon tell am again, “Make yu stop to porshu mi! Why yu won force mi to kill yu? How I go take face Joab, yor broda?”
At wons God Spirit enter Samson kon make am strong, so e go Ashkelon kon kill thirty men, den e take dia klot, kon give dem to di men wey solve di problem. Leta, e go back to en papa and mama house kon dey vex bikos of wetin happen.