14 Abner kon tell Joab, “Make wi let some boys from di two side fight face-to-face.” Joab kon ansa, “Okay.”
So twelf men from Ish-Boshet and Benjamin tribe kon fight twelf men for David side.
All of dem kut demsef for head, use swod shuk each oda for belle and di twenty-four men fall for groun die togeda. So dem koll dat place for Gibeon, “Swod Field.”
Dat day, di fight kon strong well-well and David men win Abner and Israel pipol.
Dem send Amazaya go meet King Jehoash wey bi Jehoahaz pikin and Jehu grand-pikin for Israel sey, “Make yu kom make wi si face-to-face.”
Foolish pipol dey enjoy di bad tins wey dem dey do, but pipol wey get sense, dey happy to get wisdom.
To start kworel bi like wen yu leave wota make e dey rush; so e go good make yu stop am, before e go kause big wahala.
Make yu dey sure sey dem advise yu well, before yu make any plan or go start war.
Nor kwik karry matter go kourt, bikos if anoda witness show sey na yu dey wrong, den, na wetin yu go do?