Di pawa rod nor go komot from Judah and di pawa to take rule, go always dey en leg, until e go rish di pesin wey really get am and evribody go obey yu.
Make yu let mi go house go die near my papa and mama grave. Si Kimham my pikin, make e serve yu. My king, make e follow yu, den do wetin yu know sey dey good for am.”
All di pipol for Israel kon dey kworel among demsef sey, “King David save us from awa enemies. E save us from Filistia pipol, but naw, e don run komot from di kountry bikos of Absalom.
Pipol wey dey go for Jesus front and dem wey dey follow am for back kon dey shaut, “Praiz David Pikin! Di pesin wey kom with God name, God go bless am! Make wi praiz God wey dey heaven!”