34 But Barzillai ansa. “I nor go dey dis life tey again, why I go follow my king go Jerusalem?
So di king tell am, “Make yu follow mi go Jerusalem and I go kare for yu.”
If pesin don die, e fit kom back to life? But I go wait for betta time wen dis trobol don pass mi.
My friends, wetin I mean bi sey Christ go soon kom and e nor matter if yu don marry or not.
but yu nor know tumoro. Wetin yor life bi like? Yu bi like smoke wey dey kom out from fire. Pipol go si am, den small time e go vanish.