33 So di king tell am, “Make yu follow mi go Jerusalem and I go kare for yu.”
Wen David rish Mahanaim, e si Shobi, Nahash pikin and dem kom from Rabbah town for Ammon. E still si Makir wey bi Ammiel pikin wey kom from Lo-Debar and Barzillai wey kom from Rogelim for Gilead.
Dat time, Barzillai na eighty years; e get money well-well and e feed di king wen e dey for Mahanaim.
But Barzillai ansa. “I nor go dey dis life tey again, why I go follow my king go Jerusalem?
Ziba ansa, “I go do evritin wey my king kommand.” So Mefiboshet kon dey chop for di king tabol like sey e bi king pikin.
And una wey dey sofa so, God go give wi and una rest wen Christ go kom from heaven with en mighty angels.