2 Samuel 19:28 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
28 E good make di king kill all my papa family pipol, but yu give mi pawa make I take chop for yor tabol. I nor get rite to ask for any oda tin from di king again.”
I nor deserve all di good tins and kindness wey Yu don show mi, yor savant, bikos na with only my rod I take cross Jordan River, but naw, I don divide my family and propaty into two.
“Oga, I tok to mysef sey yor promise go make mi dey save, bikos di king bi like God angel wey know good from bad. Make God wey bi yor God dey with yu!”
Di king ask am, “Where Mefiboshet, yor masta, Saul grand-pikin?” Ziba ansa, “E dey for Jerusalem, bikos dem tell am sey Israel pipol go gi-am en grand-papa Saul, kingdom back.”
Yu, yor shidren and yor savants go work for di land wey bi yor oga family own kon harvest and provide food for Mefiboshet family. But Mefiboshet ensef, go always kom chop for my tabol.” Ziba get fifteen shidren and twenty savant.
Yu don fail for yor work. As long as God dey alive, una wey nor fit protet una oga wey God choose as king, dead body betta pass una. Naw make yu find di king spear and wota pot wey dey near en head!”