Mefiboshet wey bi Jonatan pikin and Saul grand-pikin, na five years e bi wen di news kom from Jezrel sey dem don kill en grand-papa Saul and Jonatan en papa for war. Den en nurse kon karry am dey run, but bikos e dey hurry, di pikin fall from en hand, so en leg kon break.
Wen Mefiboshet wey bi Jonatan pikin and Saul grand-pikin rish der, e show respet to David kon bow for en front. David koll am, “Mefiboshet!” E ansa, “My oga, I bi yor savant.”