21 Abishai wey bi Zeruaya pikin kon sey, “Make dem kill Shimei, bikos e curse di pesin wey God choose to bi king.”
As David and en men dey waka pass, Shimei still follow dem rish di hill and e dey curse, dey trow stones and dirty for dia body.
Wen David rish Bahurim, one Saul relashon wey dem dey koll Shimei wey bi Gera pikin kom out bigin curse David.
Abishai wey en mama name bi Zeruaya kon tell di king, “My king, why yu dey let dis dog curse yu? Make I go der go kut en head komot!”
My God, make Yu favor di king wey dey guide us! Make Yu favor di one wey Yu anoint.
“Make una nor tok bad about God or curse who dey rule una.
Dem katch di pesin wey make us dey alive, di king wey God choose and wi bin get hope sey e go protet us from awa enemies.
so e kon tell en men, “Make God nor let mi do bad tin to my oga, di king wey E choose. Afta all, na God choose am.”
But David ansa, “Nor kill-am! Na who go happy sey e kill di pesin wey God ensef choose?”