Absalom sey make Amasa take Joab place as di sojas oga. Amasa na Itra pikin wey kom from Ishmael tribe and en mama name na Abigail, Nahash pikin. Zeruaya wey born Joab, na en sista bi Nahash.
All di pipol wey bilive Jesus Christ kon dey do tins togeda with one mind and nobody sey e go use wetin e get for ensef alone, so dem kon dey share dia propaty togeda.
Israel pipol for nort for Dan kountry go rish Beersheba for sout and even Gilead land for east, ansa di koll. Dem gada togeda as one for God present for Mizpa.