Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Samuel 19:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 David hear wetin Israel pipol dey tok, so e send Zadok and Abiatar wey bi priest make dem go ask Judah leaders, “Why una go bi di last to go bring di king kom back to en palis?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Samuel 19:11
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So Zadok and Abiatar karry di Kovenant Box go Jerusalem kon stay der.


Joab ansa, “I nor go waste time with yu again.” So e take three spear kon shuk Absalom for chest, even as e dey struggol for di tree wey e hang put.


Den ten of Joab sojas kon follow am kill Absalom.


Wi anoint Absalom make e bi awa king, but dem don kill-am for war. So why wi nor go-go bring David back?”


Den Israel pipol go meet di king kon sey, “Awa king, wetin make awa brodas for Judah hide escort yu, yor family and yor men cross Jordan River?”


Di king make Benaya di sojas oga for Joab place, den e put Zadok as priest for Abiatar place.


Like dat too, make yor lite shine well-well for where pipol dey, so dat dem go si di good tins wey yu dey do, wey go make dem praiz yor Papa wey dey heaven.”


Wi dey ripresent Christ, so dat God go tok to una, thru us. Wi dey beg una bikos of Christ sey, “Make una shange kon bi God friend!”


Nor bi sey wi nor get rite to ask una, but wi won use awasef as ezample for una,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ