At wons, Absalom si some of David men. So Absalom enter en horse dey run and as e dey pass under one big oak tree, di tree branches kon hook en head and e struggol till e die, bikos di horse run leave am.
Doz wey survive run enter Afek town where di town wall fall press and kill 27,000. King Ben-Hadad still run enter di town and e hide for di back room for one house.
As dem dey run from Israel pipol go di low groun for Bet-Horon, God kon make big-big stone dey fall from sky for dia head go rish Azeka. Dem die well-well and di ones wey di stone kill, many pass doz wey Israel sojas kill.