7 David men defeat Israel pipol kon kill 20,000 men dat day.
E dey do like dis to evribody for Israel wey dey kom meet di king make e judge dia matter. Like dis, evribody for Israel kon dey respet am.
David sojas go di kountry on-top di hill and dem fight Israel pipol for Efraim forest.
Di fight spread go di kountry side and di men wey die for di forest, plenty pass di ones wey dem kill for war.
Dat day, di fight kon strong well-well and David men win Abner and Israel pipol.
Abner koll Joab kon sey, “Na so wi go dey fight forever? Yu nor dey si sey wi nor go gain anytin, apart from wahala? Wi bi yor kountry pipol. Wen yu go tell yor men make dem stop to porshu us?”
David men kill three hundred and sixty among Abner men wey kom from Benjamin tribe.
King Pekah for Israel wey Remalaya born, kill 120,000 sojas for Judah, bikos dem turn from dia grand-grand papa God.
Bikos Yu don give yor kings viktory kon save yor savant David from en enemies swod.
Make yu know sey God go ponish wiked pipol; but na betta judgement go follow raitious pipol.
So my pikin, make yu fear God and honor di king. Make yu nor do anytin with pipol wey dey tok against dem,