Make all praiz bi di Most High God own, di one wey diliver yor enemies put for yor hand.” Abram kon give Melkizedek one out of evry ten tin wey e bring kom back from di war.
For di third day, one yong man run kom from Saul kamp kon bow for David front. E dey kry with pain, bikos of wetin happen and e tear en klot kon pak dirty for en head.
Today, God go give yu to mi. I go kill yu for groun kon kut yor head komot. I go give yor dead body to di bird for di sky and di wild animals for di land. Den all di land go know sey Israel pipol get betta God