2 Samuel 18:24 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
24 David sidan for di space wey dey between di inside and outside gate for di town. Di guide stand on-top di roof wey dey di gate kon si only one man dey run kom.
As dis tin happen, Absalom kon run. Dat time, one soja dey kom from work and e si many pipol dey kom from di hill for di road wey dem dey pass kom from Horonaim. So e go meet di king kon tell am wetin e si.
Ahimaaz ansa, “Anytin wey won happen, make e happen, I go-go tell am.” Joab ansa, “Oya! Make yu go.” So Ahimaaz run from Jordan River Valley pass di savant for road.
Den di king get up go sidan for di gate. Wen dem tell all di pipol sey di king sidan for di gate, all of dem kon go meet am. But all di men for Israel don go back to dia house.
Wen e rish Shiloh, Eli sidan for chair for outside dey look di road, bikos en mind dey disturb am about di Kovenant Box. As di man enter di town go tok wetin happen, di whole town kon dey kry.