Ahimaaz still sey, “I nor dey fear wetin go happen, I go-go tok di news too.” Joab ask am, “My pikin, wetin make yu won go tok? Dem nor go give yu any reward o-o.”
Ahimaaz ansa, “Anytin wey won happen, make e happen, I go-go tell am.” Joab ansa, “Oya! Make yu go.” So Ahimaaz run from Jordan River Valley pass di savant for road.