Abiatar pikin, Jonatan and Zadok pikin, Ahimaaz bin dey wait for En-Rogel wotaside wey dey for Jerusalem ending, bikos dem nor fit enter di town. One girl wey bi savant dey go tell dem wetin dey happen all di time and dem go-go tell David.
Ahimaaz ansa, “Anytin wey won happen, make e happen, I go-go tell am.” Joab ansa, “Oya! Make yu go.” So Ahimaaz run from Jordan River Valley pass di savant for road.
But Yu dey si di trobol and wahala wey dem dey kause. Yu dey si evritin; so make Yu ponish dem. Doz wey nor get help dey trust Yu and na Yu dey fight for shidren wey nor get papa and mama.
Make una nor try to pay anybody for di bad tin wey dem do una, but make una leave am for God, bikos God word sey, “Na mi go revensh for una. I go pay dem back.”