15 Den ten of Joab sojas kon follow am kill Absalom.
Naw, for evry generashon, yor shidren-shidren go die anyhow, bikos yu nor obey mi kon take Uriaya wife.
Joab ansa, “I nor go waste time with yu again.” So e take three spear kon shuk Absalom for chest, even as e dey struggol for di tree wey e hang put.
Joab hear as dem blow di trumpet make di fight for stop and en sojas wey dey porshu Israel pipol kon kom back.
David hear wetin Israel pipol dey tok, so e send Zadok and Abiatar wey bi priest make dem go ask Judah leaders, “Why una go bi di last to go bring di king kom back to en palis?
wikedness nor dey and di joy wen pesin wey nor dey fear God get, nor dey last.
Pipol wey wiked and nor dey sorry for odas, I don si as dem dey prosper like tree for betta groun,
Deat go kom meet wiked pipol wey dey always kause trobol.
Pesin wey kill anoda pesin dey kwik-kwik dig en own grave, so make yu nor try to stop am.
Anybody wey dig pit for odas, go fall enter by ensef and pesin wey break wall pass, snake go bite am.