Absalom sey make Amasa take Joab place as di sojas oga. Amasa na Itra pikin wey kom from Ishmael tribe and en mama name na Abigail, Nahash pikin. Zeruaya wey born Joab, na en sista bi Nahash.
Wen David rish Mahanaim, e si Shobi, Nahash pikin and dem kom from Rabbah town for Ammon. E still si Makir wey bi Ammiel pikin wey kom from Lo-Debar and Barzillai wey kom from Rogelim for Gilead.
Josef first-born, Manasseh, dem give en tribe some land too. Manasseh first-born Makir wey bi Gilead papa, dem gi-am land, bikos dem bi wariors. Dem give dem Gilead and Bashan.