Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Samuel 16:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 Den Absalom tell Ahitofel, “Naw wey wi don dey here, wetin yu advise make wi do?”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Samuel 16:20
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

As e dey offa sakrifice, e send message go Gilo town go koll Ahitofel, wey bi one among doz wey dey advise David. Dia plan against di king strong well-well and doz wey dey follow Absalom kon dey plenty more.


Even sef, na who I go serve, if nor bi my oga pikin? As I serve yor papa, na so I go take serve yu naw.”


Ahitofel ansa, “Go sleep with yor papa girl-friends wey e leave for di palis. Den evribody for Israel go know sey yor papa hate yu and doz wey dey follow yu, go kon get heart.”


Di kings for di world gada with rulers kon dey plan against God and di king wey E choose.


Make wi handle dem with sense, if not, dem go dey plenty more-more and if war happen naw, dem go join awa enemies fight us, den dem go run komot from dis land.”


Yor wisdom, brain and undastandin nor mean anytin if God dey against yu.


Pipol wey dey try to hide dia plans from God, nor betta pass doz wey don die! Dem dey hide do dia work for korna, dey tink sey nobody dey si or know wetin dem dey do, bikos dem dey boast sey, “Who dey si us? Who know wetin wi dey do?”


Even if una plan, una nor go susid. Make una tok anytin wey una wont, but all of dem go dey yuzles, bikos God dey with us.


For early morning, di priest oga dem and di eldas kon dey plan as dem go take kill Jesus.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ