Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Samuel 16:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 But di king tell Abishai and Joab en broda, “E nor koncern una. If e curse mi, bikos God tell am make e curse mi, who get di pawa to ask am why e dey curse mi?”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Samuel 16:10
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Even doh una mind na to kill mi, but God let am bi like dat, make betta tins for happen, so dat many pipol go dey save as una dey si today so.


But David tell Abishai and Joab en broda, “Who make una judge? Yu won give mi trobol? Na mi bi Israel pipol king naw and nobody go kill Israel pesin today,”


Den e tell Shimei, “I promise yu sey nobody go kill yu.”


Even doh na mi God choose to bi king, I dey weak today, bikos dis Zeruaya shidren too sturbon for mi. Make God ponish dis tif, bikos of wetin dem do!”


Di woman go meet Profet Elijah kon sey, “God savant, why yu do mi dis kind tin? Yu kom here kon make God remember my sins, den kill my pikin?”


“E still remain one tin: yu remember wetin Joab do mi wen e kill two kommander for Israel sojas, Abner wey bi Ner pikin and Amasa wey bi Jeta pikin. E pritend kill dem like sey dem dey fight and dat time peace dey evriwhere, kon stain en belt and sandals with innocent blood.


I wont make yu know sey na as God kommand, I go take mash kon distroy dis place, bikos God sey, “Make yu mash go distroy dis land.” ’ ”


Nobody fit stop am. E dey take wetin E won take. Nobody fit even ask am, ‘Wetin Yu dey do?’


I kwayet for yor present; I nor go tok anytin, bikos of wetin Yu don do.


Anytin wey e kommand, pawa dey follow am and nobody go fit go against or kweshon en authority.


So, na who fit tok make sometin happen, if God nor allow am?


Yu nor fit kompare God with anybody for dis world. E dey do wetin E like with di angels for heaven and pipol for dis world. Nobody fit shalenge or ask am, “Wetin Yu tink sey Yu dey do?”


But Jesus turn face Pita kon sey, “Satan, komot for my front! Yu bi stone wey block road, bikos yor mind nor dey for wetin God wont, but na wetin man wont.”


Di demons kon hala, “God Pikin, make yu leave us o-o, abi yu kom sofa us wen time neva rish?”


Jesus kon tell Pita, “Make yu put yor swod back for where e dey before! Yu nor know sey I go drink from di sofa cup wey my Papa give mi?”


But, my friend, I dey ask, “Who yu tink sey yu bi, wey make yu dey ask God kweshon? Pot wey dem mold fit ask di pesin wey dey mold am sey, ‘Why yu dey mold mi like dis?’ ”


Wen dem curse am, e nor ansa back; wen e sofa, e nor treaten sey e go pay dem back, but e put ensef for God hand wey nor dey judge kase with parsha.


So naw, make my oga di king listin to wetin en savant won tok. If na God make yu hate mi; if I offa ofrin to am, E go shange en mind, but if na human being make yu hate mi like dis, God curse go fall for dia head! Bikos dem don porshu mi komot from God land wen dem sey, ‘Make yu go. Go serve anoda god!’


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ