Kileab wey en mama na Abigail wey bi Nabal wife before and e kom from Karmel; Absalom wey en mama name na Maaka, wey bi King Talmai girl pikin for Geshur;
“But e go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una klose door make pipol nor for fit enter God Kingdom! Unasef nor won enter and una nor won make odas enter.
So Samuel take di horn wey olive oil full kon anoint di boy for en brodas front. God Spirit kon enter David body from dat day go. Den Samuel kon go Rama.