6 E dey do like dis to evribody for Israel wey dey kom meet di king make e judge dia matter. Like dis, evribody for Israel kon dey respet am.
One messenja kon go tell David, “All di pipol for Israel dey loyal to Absalom.”
Doz wey nor know God, wetin dem dey tok, fit distroy pesin, but di sense wey raitious pipol take dey tok, go save life.
I don si for dis world as evribody dey follow one yong man wey dey lead dem afta di king die.
“Di angel still sey di next king for Siria go wiked well-well. E nor get rite to bi king, but before pipol know, e go deceive dem kon bi king.
Bikos dis kind pipol nor dey serve awa Oga God Jesus Christ, but na dia belle dem dey kare for. With dia sweet and wayo mout, dem go praiz and deceive pipol wey nor wise.
and dis tishas go deceive una with dia wayo. God don kondemn dem tey-tey and Christ wey go distroy dem, nor dey sleep.