Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Samuel 15:32 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

32 Wen David rish on-top di hill where e go for fit woship God, en friend, Hushai wey kom from Ark land, wey David trust well-well, kom meet am. E wear tear-tear klot kon pak dirty full en head.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Samuel 15:32
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

For di third day, one yong man run kom from Saul kamp kon bow for David front. E dey kry with pain, bikos of wetin happen and e tear en klot kon pak dirty for en head.


Den Tamar put shako for en head, tear en gown kon use en hand kover en face as e dey kry dey go.


David kon go Mount Olives bigin kry. E nor wear any shoe and e kover en head to show how e nor dey happy. All di pipol wey follow am still kover dia head as dem dey kry.


Wen David don pass di hill small, e kon si Ziba wey bi Mefiboshet savant. E bring some donkey wey karry two hundred bread and some kake; one hundred fresh fruit and one leda bag wey wine full.


Absalom and Israel pipol enter Jerusalem and Ahitofel dey with dem.


So Absalom sey, “Make una koll Hushai make wi hear wetin e won tok.”


For di east side for Jerusalem hill, e build where dem for dey woship Kemosh, wey bi Moab pipol yeye god and Milkom, wey bi Ammon pipol god.


Baana wey bi Hushai pikin dey kare for Asher aria and Bealot town.


Na Ahitofel dey advise di king, while Hushai from Ark, na di king very good friend.


My God, make Yu get up! My God, make Yu save mi! Yes, Yu go slap all my enemies for dia face kon break dia tit!


Afta, make una koll mi wen una dey trobol and I go kom save una, den una go give mi all di glory.”


Wen dem koll mi, I go ansa dem; I go dey with dem wen dem dey trobol. I go save and make pipol honor dem.


Wen e rish Betpage and Betany, for di place wey dem dey koll Mount Olives, e kon send two of en disciples sey,


Di borda for sout wey from Bethel go Luz kon cross go Arkite aria for Atarot.


Dat day, one man from Benjamin tribe run from di war front go Shiloh. E shirt don tear and dirty full en head.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ