Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Samuel 15:31 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

31 Wen dem tell David sey Ahitofel don join Absalom against am, e kon pray, “Oga God, I beg! Make any word or advise wey Ahitofel tok, dey yuzles!”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Samuel 15:31
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

As e dey offa sakrifice, e send message go Gilo town go koll Ahitofel, wey bi one among doz wey dey advise David. Dia plan against di king strong well-well and doz wey dey follow Absalom kon dey plenty more.


Dat time, any advise wey Ahitofel give, David and Absalom dey do as e tok, bikos dem bilive sey God dey tok thru am.


Absalom and Israel leaders kon sey, “Hushai advise betta pass Ahitofel own.” God don decide sey dem nor go follow Ahitofel good advise, so dat wahala go follow Absalom.


Wen Ahitofel si sey dem nor follow en advise, e enter en donkey go en own town. Wen e don setol all en matter, e kon hang ensef. Dem beri am for dia family grave.


So Absalom sey, “Make una koll Hushai make wi hear wetin e won tok.”


Hushai ansa, “Di advise wey Ahitofel give yu dis time nor good.


E skata and make sure sey wayo pipol nor fit do wetin dem plan!


Dem gada round mi kon dey lie and fight mi without any rizin.


My God, make Yu si as my enemies many rish! Many of dem dey kom attack mi.


Even my best friend, di one wey I trust with evritin; pesin wey wi dey chop togeda, don turn against mi.


Both for day and nite, dem dey waka on-top di town wall and na wikedness and distroshon full der.


If to sey na enemy dey laf mi, I for fit bear-am. If to sey na enemies dey make mout for mi, I for fit hide from dem.


I go distroy Egypt pipol with fear kon make dia plans yuzles. Dem go-go meet dia juju for help kon tell doz wey don die make dem advise and ansa dem.


Na mi dey fool pipol wey dey si vishon kon make dia work taya dem. I dey shange wise pipol advise to anoda tin kon turn dia wisdom to foolishness.


“Wetin I dey tok so nor koncern all of una, bikos I know di pipol wey I choose. Dis show sey God word na true sey, ‘Di pesin wey follow mi chop don turn to my enemy.’


Wetin happen to di wise pipol? Wetin happen to doz wey know Moses Law well-well? Wetin happen to doz wey tink sey dem get all di ansa? Abi God nor sey dis world wisdom, nor mean anytin?


Dat kind wisdom nor kom from God, but e kom from dis eart wey wiked well-well.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ