David kon go Mount Olives bigin kry. E nor wear any shoe and e kover en head to show how e nor dey happy. All di pipol wey follow am still kover dia head as dem dey kry.
David hear wetin Israel pipol dey tok, so e send Zadok and Abiatar wey bi priest make dem go ask Judah leaders, “Why una go bi di last to go bring di king kom back to en palis?