All di pipol for di town bigin kry as David with en men dey go. Di king with en men wey dey follow am kon cross go Kidron Valley as dem waka face di wildaness.
David ask am, “Wetin yu won use all dis tin do?” Ziba ansa, “Di donkey na for my king, David family, di bread and di fruit na for di men to chop and na di wine dem go drink wen dem don taya for di wildaness.”
Hushai still sey, “Make una kwik dey go naw kon tell David make e nor stay for where e dey dis nite for di desert, but make e cross Jordan River, so dat dem nor go kill en and en men.”