Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Samuel 15:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 “E neva too tey wey yu kom here, so wetin go make mi allow yu sofa with mi? I nor even know where I dey go. So, make yu go back go meet yor pipol and make God dey kind and trit una well.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Samuel 15:20
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

e kon send some men go tell dem sey, “Make God bless una as una take honor una king kon beri am.


Make God dey kind and faithful to una. Misef go trit una well bikos of wetin una do so.


All doz wey dey keep God kommand and obey en laws, E dey show dem en faithfulnes kon lead dem with love wey nor dey fail.


Yu know di pains wey I dey face. As I dey kry, Yu put all my tear for bottol kon rite wetin I dey sofa for yor book.


and E go send help kom from heaven kon save mi, den disgrace doz wey won kill mi. My God go send en goodness and love wey nor dey fail kom.


Dem dey find food to chop and even wen dem si chop, di food nor dey rish dem.


Make di king rule with God proteshon forever. Make yor love wey nor dey fail and faithfulnes, keep di king.


Den, I go dey sing praiz yor name forever kon dey do wetin I promise Yu.


Love wey nor dey fail and trut, don join togeda. Raitiousness and peace don kiss each oda.


Na raitiousness and justice Yu take make di foundashon for yor throne. Yu dey rule with trut and love wey nor dey fail.


If yu plan to do bad, yu go lost; but if yu plan to do good, yu go get love and faithfulnes wey nor dey fail.


So make yu always get faith and dey honbol; tie trut and mesi round yor neck kon rite dem for yor heart.


“Pipol go dey waka up-and-down from Dead Sea go Mediterranean Sea kon from nort go east. Dem go dey find God message for evriwhere, but dem nor go si am.


Na thru Moses God give us di law, but God give us favor and trut, thru Jesus Christ.


So David and en six hundred men kon run komot Keilah; dem kon dey go from one place to anoda. Wen dem tell Saul sey David don run komot Keilah, e nor kon go der again.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ