15 Dem ansa, “Yes o-o, awa king! Wi dey ready to do anytin wey yu tok.”
So David tell all en ofisas wey dey with am for Jerusalem, “Make wi run at wons, so dat Absalom nor go kill us! Make una hurry or e go kom defeat and kill evribody for di town!”
So di king karry all en family pipol with di ofisas kon leave ten of en girl-friend wey go look di palis.
Ziba ansa, “I go do evritin wey my king kommand.” So Mefiboshet kon dey chop for di king tabol like sey e bi king pikin.
Friendship if put yu for trobol, but some friends go dey klose to yu pass yor own broda.
Una go bi my friend if una do wetin I tok.
Di savant ansa, “Make yu do evritin wey dey yor mind. Do as yor mind dey tell yu. I dey with yu go rish di end.”