One day, all of us go must die, bikos wi bi like wota wey pour for groun wey dem nor fit gada again. But God nor dey kill pesin, instead E go tink of how E go take bring di pesin kom back to ensef.
I know sey yu go listin to mi kon save mi from di pesin wey dey try to kill mi and my pikin, so dat dem go remove us from di land wey God give en pipol.