Abraham sey, “My Oga God! Abeg make Yu nor vex for yor savant. Wot of if dem bi ten wey dey fear Yu for di town?” God ansa, “I nor go distroy di town bikos of dat ten.”
Di woman sey, “My king, abeg make yu pray give yor God, so dat my rilashons nor go kommit di crime wey big pass di first one kon go kill my oda pikin.” David ansa, “I use God name take promise sey nobody go tosh yor pikin.”
Di woman tell am, “Why yu do dat kind tin to God pipol? Yu neva let yor own pikin kom back from where e hide put since, so yu don kondemn yorsef with wetin yu just tok so.
My God, Yu dey always trit mi well anytime wey I komplain give Yu. But I ask Yu one kweshon about good judgement: “Why e bi sey wiked pipol dey prosper and pipol wey nor dey honest, dey susid?
Abigail fall for groun kon sey, “My oga, I gri sey wi dey wrong. But abeg make yu let yor woman savant follow yu tok. Make yu listin to wetin yor savant get to tok.