9 E remove di kake from di pan kon go give Amnon make e chop, but e nor gri chop, instead e sey, “Make evribody go outside,” den all of dem kon komot.
Josef nor fit kontrol ensef again so e kon sey, “Make evribody komot for my front naw!” Nobody dey der with Josef wen e tell en brodas who e bi.
Den Amnon tell Tamar, “Bring di kake kom give mi for bed, den serve mi by yorsef.” So di girl karry di kake go where e dey.
Wen di girl go der, e si Amnon sleep for en bed, so e take flower kon bake kake for en front.
Yu si, evribody wey dey do bad tins dey hate lite and dem nor go gri kom out for where lite dey, make pipol nor for si di bad tins wey dem dey do.
But Ehud go back go meet King Eglon and wen e rish di Idol Stone near Gilgal, e kon tell am, “My oga, I get one sekret message for yu.” So di king kommand en savants, “Make una kwayet!” Den e sey make dem komot from di room.