2 Samuel 13:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
4 Jonadab ask Amnon, “Wetin make di king pikin dey vex evry morning? Naw, make yu tell mi wetin dey happen?” Amnon ansa, “I love Tamar wey bi my half broda Absalom, sista.”
Jonadab tell am, “Make yu do like sey yu nor well kon go liedan for bed. If yor papa kom si yu, den yu go tell am sey, ‘Abeg, make yu tell Tamar my sista sey make e kom give mi food. I wont make e make di food for here where I go dey si am, den serve mi by ensef.’ ”
Dia face dey show sey dem dey guilty. Just like di pipol for Sodom, na so too dem dey boast about dia sin. E bad well-well for dem, bikos dem dey distroy demsef.
Dem dey shame sey dem do dis kind wiked tins? ‘No!’ Dem nor dey shame at-all; dem nor even sabi form sef! Bikos of dis, just as pipol wey don die, na so too dem go die finish afta I don ponish dem.” Mi, wey bi God, don tok.
“ ‘Make una nor go sleep with una sista, weda na una papa or mama pikin; or weda dem born am for di same house or outside; una must not sleep with dem.
If anybody sleep with en own sista, weda na en papa or mama pikin and dem si each oda nakednes, na big disgrace e bi. Una must komot dem from where dia pipol dey. E don disgrace en sista, so e go bear di ponishment for en sin.