39 But wen di king don forget about Amnon deat, e kon dey hongry to si Absalom again.
Den Isaak take Rebekah enter en mama room. E take am as en wife kon love am. So, Rebekah make Isaak mind rest, afta en mama don die.
And naw yu just dey go, bikos e don tey wey yu dey won go yor papa house, but wetin make yu tif my gods?”
All en sons and dotas stand near am dey kounsol am, but e nor gri ansa dem. So Jakob kon kry well-well for Josef.
Afta sometaim, Judah wife wey bi Shua pikin kon die. Afta Judah don mourn for am, e kon go Timnah go visit doz wey dey barb sheep hair with en friend Hirah wey kom from Adullam.
Joab know sey David won si Absalom,
I always dey happy to dey learn yor rules and laws.
I really love to dey di kourt wey dey God temple. My heart and my whole body dey shaut for joy, bikos of God wey dey alive.
God go give una shidren to oda pipol and even as una dey look dis tins, una nor go get pawa to do anytin.
True-true, e miss all of una well-well and en mind dey worry am, bikos una hear sey e nor well.