36 As e just tok finish, David shidren kon enter inside. Dem bigin kry and David with all en ofisas kry well-well too.
En ofisas tell am, “Wi nor undastand dis tin! Wen di pikin dey live, yu kry for am and yu nor gri chop, but as e just die, yu get up go chop!”
Afta Amnon don sleep with Tamar, e kon hate am pass di wey e love am before. Den e tell am, “Make yu get out komot here!”
Jonadab tell David, “Just as I tell yu, na yor shidren dem dey kom so.”
Absalom run go meet Geshur king kon stay der with Talmai wey bi Ammihud pikin. But na evriday David for en son.
Di king nor kon happy again. So e go di room wey dey di gate side kon bigin kry. As e dey go, e dey kry sey, “O-o! My pikin Absalom! Absalom my pikin, e for betta sey na mi die, instead of yu!”