35 Jonadab tell David, “Just as I tell yu, na yor shidren dem dey kom so.”
As dis tin happen, Absalom kon run. Dat time, one soja dey kom from work and e si many pipol dey kom from di hill for di road wey dem dey pass kom from Horonaim. So e go meet di king kon tell am wetin e si.
As e just tok finish, David shidren kon enter inside. Dem bigin kry and David with all en ofisas kry well-well too.