Afta sometaim, Judah wife wey bi Shua pikin kon die. Afta Judah don mourn for am, e kon go Timnah go visit doz wey dey barb sheep hair with en friend Hirah wey kom from Adullam.
Afta two years don pass, wen Absalom won kut hair komot from en sheep body for Baal-Hazor, wey dey near Efraim town, e kon invite all di king sons kom der.
Di king ansa, “No my pikin, if wi kom, di wahala go too mush for yu.” Absalom still dey beg make di king kom, but e nor gri, instead e sey make Absalom dey go.