2 Samuel 13:23 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
23 Afta two years don pass, wen Absalom won kut hair komot from en sheep body for Baal-Hazor, wey dey near Efraim town, e kon invite all di king sons kom der.
E don use many goat, sheep and fat melu take do sakrifice and e invite Abiatar di priest, yor shidren and Joab wey dey kommand yor sojas, but e nor invite Solomon.
Bikos, today, e don use many sheep, goat and fat melu take do sakrifice. E invite all yor shidren, Joab wey dey kommand yor sojas and Priest Abiatar and as wi dey tok so, dem dey do party dey shaut sey, ‘Adonijah, yu bi king! Make yu live forever!’
One day wey Adonijah go sakrifice sheep and fat melu to God on-top di Snake Stone (Zohelet Stone) near En-Rogel wotaside, e invite di oda shidren wey David born and di ofisas wey kom from Judah make dem kom di sakrifice,
E still build towas wey e fence; dig many well for di desert, bikos e get many animals for di hills and plain land. E get pipol wey dey work for am for en farm, vineyard, di hills and for Mount Karmel, bikos e like farm work well-well.
E get one man for Maon and e dey sell for Karmel town. Dis man get money well-well; e get 3,000 sheep and 1,000 goats. Dat time, e dey barb en sheep hair for Karmel.
Wen Abigail go back go meet Nabal, e dey do party for en house like king. Nabal dey enjoy ensef and e don drink well-well. Abigail nor tok anytin until di next day.