David take gold crown from Ammon pipol juju wey bi “God Milkom” and di gold heavy rish seventy-five pound and jewel dey inside am too. David take am kon wear am for en own head. E still karry many tins from di town.
Wen David rish Mahanaim, e si Shobi, Nahash pikin and dem kom from Rabbah town for Ammon. E still si Makir wey bi Ammiel pikin wey kom from Lo-Debar and Barzillai wey kom from Rogelim for Gilead.