Afta one week, di pikin kon die and fear nor let David ofisas tell am di news. Dem sey, “Wen di pikin dey life, David nor dey ansa us wen wi tok to am, na how wi go take tell am sey di pikin don die? E fit go wound ensef o-o!”
So David stand up go baf; e komb en hair kon shange en klot. Den e go woship for God house. Wen e rish di palis, e ask for food and e chop am as dem just bring am.