12 Yu sin for sekret, but I go make dis tin happen for publik make all Israel pipol si am.”
So dem set one tent for di palis roof for Absalom and for evribody present, Absalom enter kon sleep with en papa girl-friends.
den make my wife kook for anoda man chop and make e sleep for anoda man bed.
E nor get as di darkness tick rish, e nor fit hide sinnas from God.
For evritin wey wi dey do, make wi know sey God go judge us; even di ones wey wi do for sekret, weda dem dey good or bad.
So, make una nor judge anybody until Christ go kom back. E go espose evritin wey dey darkness and di tins wey dey inside pesin heart. Dat time, na God go praiz evribody akordin to wetin dem do.