Uriaya ansa, “Israel and Judah men with di Kovenant Box dey war; Joab wey bi my kommander and en ofisas, kamp for open place. How I go take go house go chop, drink and sleep with my wife? So, I use evritin wey dey holy take swear sey I nor go fit do dat kind tin.”