24 Israel wimen, make una mourn for Saul! E dey give una fine klot, jewel and gold.
I love Saul and Jonatan well-well. Deat nor go fit separate dem. Dem fast pass eagle and strong pass lion.
Di sojas wey strong well-well don fall, dem kill dem for war; naw, Jonatan don die for di hill.
“Kings and dia sojas dey run!” So Israel wimen kon divide dia propaty.
Wen wise pesin advise pesin wey ready to listin, wetin e tok, betta pass fine gold ring or necklace.
E nor dey worry if kold dey, bikos en family get klot wey go make dem warm.
Yong woman dey forget to wear en gold ring? Abi woman wey won marry, dey forget to wear en marriage klot? But e don tey wey my pipol don forget mi.
‘May bi dem dey divide di tins wey dem seize; dat is, one girl or two for evry man. Sisera dey gada fine klot; klot wey dem design well. Yes! Fine-fine robe wey dem design for di two side, dey join wetin dem seize.’