Benaya, wey bi Jehoiada pikin, wey kom from Kabzeel, na anoda popula soja. E do many strong tins kon kill two men among Moab strong sojas. One day, e still waka enter one pit go kill lion.
Some strong sojas for Gad wey dem don train for war kon go join David too. Dem dey karry shield and spear. Dem bi like wiked lion and dem dey run fast like deer wey dey di hill.
Yes, di enemies go kom like kloud. Dia shariot bi like strong breeze and dia horse fast pass eagle.” Den I kon kry, “Wi don die finish o-o, bikos dem go distroy us!”
So for di sevent day, as evening dey rish, di men kon tell Samson di ansa sey, “Na wetin go fit dey sweet pass honey or wish tin or animal strong pass lion?” But Samson ansa dem, “If to sey, una nor work with my melu, una nor for know di ansa.”
Jonatan ansa am, “Nor-tin go fit kill yu! My papa nor go fit do anytin escept e tell mi first. Wetin make my papa nor gri tell mi about dis matter? E nor go fit happen!”