Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Samuel 1:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 Make yu nor announce am for Gat or for Ashkelon strits. So dat Filistia wimen and di pipol wey dey woship juju, nor go happy.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Samuel 1:20
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Naw, I don raiz my hand won ponish yu kon take yor share for di blessing, komot yor hand. I don give yu to Filistia pipol; pipol wey hate yu and dem nor like di life wey yu dey live.


wen yor wikedness neva bring yu kom out? Naw, yu just bi like am, bikos Edom, Filistia pipol and yor neighbours wey hate yu, dey laf yu naw.


Make una nor tell Gat pipol; make una nor let dem si una kry. Make una sidan for groun for Bet-Leafra kon pak san full una head.


Wen Jeftah rish en house for Mizpa, en only pikin wey e get for en life, run kom out kon meet am, dey dance and play tamborin with happiness.


At wons God Spirit enter Samson kon make am strong, so e go Ashkelon kon kill thirty men, den e take dia klot, kon give dem to di men wey solve di problem. Leta, e go back to en papa and mama house kon dey vex bikos of wetin happen.


Jonatan kon tell en savant, “Kom make wi go di oda side go meet all dis men wey dem nor sekonsaiz. May bi God fit fight for us. Nor-tin go fit stop God to save us, weda dem many or small.”


David ask di men wey stand near am, “Na wetin dem go do for di man wey go kill dis Filistia man kon free Israel from shame? Bikos who bi dis Filistia man wey nor sekonsaiz, wey dey shalenge God wey dey alive, sojas?”


Yor savant don kill both lion and bear. Dis Filistia man wey dem nor sekonsaiz go bi like one of dem. Bikos e don shalenge God wey dey alive sojas!”


Wen dem kom back afta David don kill Filistia pipol, di wimen for di town kom out kon dey sing, dey dance go meet King Saul. Dem dey happy as dem dey play dia instruments dey kom.


So, Saul kon tell en savant wey dey karry en swod sey, “Draw yor swod make yu stab mi, so dat Filistia sojas wey dem nor sekonsaiz, nor go kill mi.” But di savant nor gri stab am, bikos e dey fear. So Saul take di swod kon kill ensef.


Dis na di towns wey Filistia pipol leaders for bring di gold sore wey dem offa to God, so dat E go forgive dem dia sin: Ashdod, Gaza, Ashkelon, Gat and Ekron.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ