Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Pita 3:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Afta dis, make una undastand sey: for di last days, yeye pipol go kom and dem go dey do bad tins wey dey hongry dem.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Pita 3:3
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Pipol wey nor get sense, na how long una won take bi fool? Na how long una won take wisdom do yeye? Una nor won learn at-all?


Pipol wey karry body up dey find wisdom, but dem nor go si am, but undastandin dey eazy for pesin wey get sense.


God nor get wetin E won do with proud pipol, but E dey favor pipol wey dey honbol.


So, all di sturbon and wiked rulers for Jerusalem, make una listin to wetin God dey tok.


Bikos pipol wey dey opress odas go vanish and all doz wey like to dey do bad tins, go die.


Dem dey sey, “Make God kwik do wetin E sey E go do, so dat wi go si. Make Israel God wey dey Holy do wetin E plan, so dat wi go know.”


Wen di king dey do party, en and en ofisas dey drink well-well and dem go dey make plans with yeye pipol.


Anybody wey rijet mi and nor do wetin I tok, God go use dis my word judge am for di last day.


But wi don stop to dey do wiked tins wey pipol dey hide dey do; wi nor dey do wayo or lie join God word, but with trut wey evribody fit si, wi dey make evribody know for dia mind sey, wetin wi dey do, dey good for God eye.


Make yu undastand sey, for di last days before dis world go end, tins go hard well-well.


but naw, E dey tok to us thru en pikin wey get evritin and na thru am, E kreate di world.


Di one wey important pass bi sey, una know dis tins: e nor get anytin wey di profets tok for God word wey just kom out from dia own mind,


Dis na di pipol wey dey do wetin dia body wont and dem nor dey respet pipol wey get authority. Dem nor dey fear; dem dey karry body up; dey tok bad about tins wey God kreate for heaven,


My shidren, di world don dey end and just as una hear sey, anti-Christ dey kom, make una know sey many anti-Christ don already kom. And dis show us sey di world go soon end.


Dis pipol dey komplain waka and dey find fault. Dem dey go anywhere wey dia body karry dem go and dem dey boast. Dem dey tok wetin pipol like to hear, so dat odas go praiz dem.


Dem sey, “For di time wen dis world won end, some pipol go dey laf una and di tins wey God hate wey dey hongry dem to do, naim go dey push dem.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ