18 But make una grow inside di grace wey awa Oga God and Savior, Jesus Christ give una, so dat una go know am more-more. Make glory bi en own, naw and forever! Amen.
But for una wey dey fear my name, my sun wey dey give life go shine and heal una. Una go dey free kon dey happy like melu pikin wey dem open en kage make e for go play.
so dat evribody go bow down for di pikin as dem dey bow down for di Papa. If anybody nor bow show respet for di pikin, e nor go get di mind to respet di Papa wey send di pikin kom.
Bikos God wey sey, “Make lite shine from darkness,” Na-im dey shine inside awa heart, so dat E go give us di lite wey show us en glory wey dey Christ face.
Nor bi only doz ones, but naw, I dey look evritin as nor-tin, wen I kompare am with Christ, my Oga God wey I know and I trowey evritin, bikos of am. True-true, I dey look all doz tins as yeye, so dat I go fit gain Christ,
I pray make God pawa give us evritin wey wi nid, so dat wi go fit live di kind life wey E wont, as wi don know di trut about Jesus wey koll us with en glory and goodness.
Bikos if una really get dis tins, dem go dey grow inside una, so una nor go dey yuzles, but una go bear good fruits as una dey try to know Christ more-more.
Afta dem don free from sin thru awa Oga God and Savior Jesus Christ and dem kon let sin masta dem again, dia kondishon for di end, go worse pass as e bi before.