Wen I dey with una for my sekond visit, I tell una wey dey sin before about dis tins. Even doh I nor dey with una naw, I dey tok am again sey, if I kom again, I nor go sorry for anybody, but I go ponish am,
Make yu nor hurry to make pesin leader and nor rush put hand for en head, so dat yu nor go karry anoda pesin sin for yor head. Make yu keep yorsef pure.
But as for una wey bi my friends, even doh wi dey tok to una like dis, wi know sey dis tins nor go happen to una, bikos una don undastand God salvashon.
So, my friends, as una dey wait for dis tins, make una do wetin una fit do, so dat una go get peace and una go dey without stain or fault wen una go enter en kingdom.
So, my friends, as una don know wetin go happen, make una shine una eye, so dat una nor go miss di way and fall from di trut wey una get, bikos na so pipol wey nor sirious, dey do.