Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Pita 2:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 Bikos e for betta sey, dem nor know God at-all, dan sey afta dem don know am, dem kon turn back from di kommandment wey God give dem.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Pita 2:21
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

but make Yu ponish pipol wey dey do bad tins. Ponish dem with all di oda wiked pipol. Make peace always dey Israel land!


I go listin to wetin Oga God tok, bikos E go make peace with en pipol; doz wey dey obey am, so-far dem nor go-go back to dia wiked and yeye ways.


Doz wey dey follow God, go get life and dis way wey dem dey follow, nor dey kause deat.


Na long life bi raitious pipol reward and to get white hair, na betta crown.


“But if one good man stop to do good kon dey do bad and wiked tins wey bad pipol dey do, yu tink sey e go live? No! Dem nor go remember any good tin wey e do. E go die, bikos e nor gri obey my law and e dey sin.


I si sey e bad well-well. Dat is, di sekond sista kon dey do like di first one.


“If betta pesin kon start to do wiked tins and I kause wahala for am, e go die if yu nor warn am. E go die bikos of en sins; I nor go remember di good tins wey e do and I go whole yu for en deat.


I fit promise good man good life, but if e bigin tink sey di good wey e do before go save am, den e start to sin, I nor go remember all di good wey e do. E go die, bikos of en sins.


I go distroy doz wey bin dey woship mi, but nor dey woship mi again. Dem nor dey ask make God guide or bless dem again.”


John di Baptist kom show una di true road and una nor bilive am. But tax kollectors and ashawo dem bilive am. Even wen una si all dis tins wey I do, una still nor shange una mind kon bilive God.”


“Di savant wey know wetin en oga wont and e nor do am, dem go flog am well-well.


If to sey I nor kom tok to dem, dem for nor dey guilty for dia sin. But naw, dem nor get any eskuse for dia sin.


Jesus ansa dem, “If una gri sey una blind, God nor go kondemn una bikos of una sin, but as una tok sey una dey si so, una sin dey for una head.”


Make una help karry each oda load and if una do like dis, una dey obey Christ.


Una know di kommand wey wi give una thru Christ.


make yu obey dia kommand without fault or blame, until awa Oga God Jesus Christ go kom.


If wi kontinue to sin afta God don show us di trut, e nor get any oda sakrifice wey go fit forgive us awa sins again.


So anybody wey know wetin good and e nor do am, don kommit sin bi dat.


I wont make una remember all di word wey di profets tok before and di kommandment wey awa Oga God and Savior give us thru di apostles.


My friends, even doh e don dey hongry mi since to rite give una about di salvashon wey wi dey share togeda, naw e strong well-well for my mind to rite, so dat una mind go dey strong. So una go fit stand fight for wetin wi bilive; di tins wey God don give en pipol and nor-tin go fit shange am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ