19 Even doh dis fake tishas dey promise dis pipol sey, dem go dey free, di fake tisha na slave dem bi to sin. Bikos pesin na slave to anytin wey masta am.
Efraim pipol, una own don finish! Una glory dey fade like flower wey breeze blow trowey, bikos una leaders don drink well-well and even with all di perfume wey dem spray, dem still sleep for dirty, bikos di drink don katch dem well-well.
Dis na wetin God tok about lie-lie profets: “Dem don break my heart and all my body dey shake. I bi like pesin wey don drink wine well-well, bikos of di wey dem dey trit mi and my holy word.
Naim di man wey di evil spirit dey inside en body kon jump for dia body beat dem well-well, until dem start to beg. E beat dem till dem run komot from di house with nakednes and all dia body full with sore.
Den dia sense go korrect and dem nor go fall enter devil trap again. Bikos devil don katch dem put inside en trap before, so dem dey do anytin wey e wont.
Before naw, wi dey bihave like fool; wi nor dey obey; wi dey deceive pipol; wi bi savant to tins wey dey sweet us; wi dey do bad tins and dey jealous odas; pipol hate us and wi hate dem too.
Afta dem don free from sin thru awa Oga God and Savior Jesus Christ and dem kon let sin masta dem again, dia kondishon for di end, go worse pass as e bi before.